Fire Burn Plenti Goods wey cost Millions of Naira for Ikoku

January 20, 2023

Over 60 shops with goods wey worth millions destroy this morning sake of say fire for Ikoku spare part market happen this morning.

Our Tori person, Allwell Ene who bin dey where e happen this morning gather say di fire start and na poor power supply cause am.

President of the Port Harcourt Motor spare part dealers union Festus Onyenwe while he dey narrate the incident took say na the help of the federal fire service wey dem take quench am.