Federal High Court Don Nullify Rivers APC Primaries

November 24, 2022

Justice E. A Obile of the Federal High Court wey sit down for Port Harcourt don disqualified Tonye Cole as Rivers State Governorship candidate of the All Progressives Congress.

Justice Obile disqualify Tonye Cole based on dual citizenship sake i=of say e voluntarily collect citizenship of the United Kingdom and him declare allegiance to the same country, E folo talk say e no duly dey nominated by him political party and noncompliance with provisions of the Electoral  Act.

Dem also disqualify Tonye on groundssay the primaries wey APC conduct violate sections of the electoral act and say INEC no monitor am.

PDP lad counsel Dike Udenna tell tori pipo say with this ruling INEC no go fit allowTonye Cole as the candidate of the APC for the 2023 elections.

Counsel to the APC Collins Dike for him own part say the APC go appeal the judgement of the court.