FEDERAL GOVERNMENT DON CANCEL APC PRIMARIES

October 27, 2022

One Federal high court sitting inside pitakwa, don cancel all di primaries wey di All Progressive Congress (APC) don do for inside Rivers state ahead of the 2023 election. And e be like say dis kind tin bin don shele before, for 2019.

Di plaintiffs wey carry this matter come court, George Orlu and five others, bin don file one suit against di All Progressive Congress say dem deny dem di nomination form and still minus dem comot as di delegate congress wey bin happen, so dem dey tell court to cancel the primaries.

After di court don listen to di preliminary objection and the application for joinder, Justice E.A Obile come talk say di act of di first defendant of di APC wey no give nomination to di accuser, say e no follow for constitution at all plus say this accusers follow get right to vote and be voted for.