Di Presidential Election Petitions Court go hear di petitions wey dey challenge Bola Ahmed Tinubu victory for di 2023 general elections on Monday 8 May.
According to di team of di All Progressives Congress (APC) candidate, Bola Ahmed Tinubu, di hearing na pre-hearing session local tori pipo ChannelsTV report.
Di session go settle pending application, and dem go set timetable for hearing of di substantive matters.
Di Independent National Electoral Commission (INEC) declare Tinubu as president-elect afta im score 8,794,726 votes.
Tinubu close rival Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party (PDP) poll 6,984,520 while di candidate of di Labour Party (LP) Peter Obi get 6,101,533 votes