EFCC don recover N32.7bn and $445,000 for Humanitarian Ministry probe

April 15, 2024

The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don talk say dem don recover N32.7 billion and $445,000 from top officials of di Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development.

Dem still talk say some banks wey dey involved for di ministry scandal dey under investigation, and di Managing Directors of di implicated banks don give useful statements to EFCC investigators.

But EFCC talk say dem never clear any of di suspects wey dey involved for di fraudulent deals wey dey under investigation, but dem go prosecute those wey dem find guilty.

EFCC, wey give dis update for one statement wey dem release on Sunday through dia Head of Media and Publicity, Dele Oyewale, talk say dem don open discreet investigations on top oda fraudulent deals wey involve Covid-19 funds, di World Bank loan, and Abacha recovered loot wey dem release to di Ministry.