Drunk Driver kill pregnant woman, 13 odas for Calabar Bikers carnival

December 28, 2022

One accident for Bikers Carnival inside Calabar, Cross Rivers state, south-south Nigeria don leave 14 dead and anoda 24 for inside hospital, na so police tok.

Irene Ugbo, toktok pesin for di state police confam di mata to BBC Pidgin.

β€œI no know wetin happun but di driver dey on hight speed wen he lost control and run into di crowd of pipo wey dey watch di Biker’s Carnival,” eyewitness tok.

Di Police toktok pesin say, “na one drunk man wey bin drive enta di place wia pipo bin gather to attend di bikers parade wey suppose happun today”.

“Di culprit don dey for inside police custody afta di attack,” Police Superintendent Ugbo add.