On Tuesday night di goment meet di striking resident doctors to beg dem to suspend dia strike sake of say dem ready to meet di demands.
Di Nigerian Association of Resident Doctors (Nard) don reveal update on dia indefinite strike and why dem suspend dia nationwide protest wey dem wan use to press home dia demands on Wednesday.
Remember say di resident doctors for Nigeria embark on an indefinite strike for July 26, 2023, wia dem dey demand better welfare of dia members among oda requests. Di doctors bin give goment two-week ultimatum bifor but goment no meet dia demands wey later turn to di strike wey dem begin.
Sadly, goment release one letter on Tuesday 1 August through di federal ministry dem order di implementation of a ‘no work, no pay’ policy for di doctors wey dey strike. Di striking doctors immediately declare a nationwide protest wey suppose begin on Wednesday.
Dem doctors suspend dia planned nationwide protest for Wednesday morning afta dem meet wit goment representatives wia dem promise to dey meet di demands.