Guinea-Bissau president say heavy gunfire wey break out for di capital on Friday na attempted coup.
Im bin dey out of di kontri dat time, dey attend di UN COP28 climate conference in Dubai.
On Saturday, President Umaro Sissoco Embaló promise “serious consequences” for pipo wey get hand for di mata.
Dis na di second failed coup against im leadership in under two years. Di unrest begin late on Thursday evening into Friday mid-morning.
Dem don gbab one man wey dem describe as di leader of one group of sojas wey bin try to free one detained minister and one senior state official for Guinea-Bissau, di military tok.