Dem don amputate Mr Ibu leg – Family Tok

November 6, 2023

Dem don amputate di leg of popular Nollywood actor and comedian, John Okafor wey pipo sabi as Mr Ibu.

One of im family member, Chioma Okafor announce am for im Instagram account on Monday, 6 November.

She post say “As at 1pm today, Daddy don go through seven successful surgeries but to keep am alive and increase im chances of recovery, dem gatz amputate one of im legs.”

Chioma add say di development dey hard on di family but dem don accept dia papa new reality to keep am alive.

Di actor for sometimes now don dey struggle wit im health but di nature of im sickness no dey clear.

Recently, for one video wey di actor post on im Instagram account wey go viral, e show as e dey beg im fans to help and pray for am.

Di actor tok say im don dey hospital for sometimes now sake of one “strange and dangerous illness”.

E say doctors don recommend make dem cut im legs.