Aliko Dangote, wey be President of Dangote Group, don show the first sample of Premium Motor Spirit, wey people sabi as petrol.
Dangote present the sample on Tuesday for live video wey dem do from him refinery for Ibeju-Lekki area of Lagos State.
The 650,000 capacity refinery don test the product.
“I wan hail the people of Nigeria and the government of President Bola Tinubu for the platform wey dem give us for growth, development, and prosperity. I go also like thank am personally for the idea of Naira for crude. This one go make Naira strong well well. As this refinery don dey work, e go show the true consumption of Nigeria; we fit track every truck and ship wey dem load,” na wetin him talk.
E still talk say him refinery no go only meet the needs of Nigerians, but e go also serve Sub-Saharan Africans.