Office of di Tibetan spiritual leader say e wan tok sorry to di small boy and im family “for di hurt im words fit don cause”.
Di video also show as di Dalai Lama dey kiss di pikin on im lips.
“Im Holiness dey often tease pipo e meet in innocent and playful way, even for public and before cameras. He regret di incident,” im office tok.
Di video don spark widespread criticism, as many social media users say e dey inappropriate and disturbing.