‘Continue to spend your old 500 and 1000 naira notes’ – El-Rufai to Kaduna pipo

February 17, 2023

Di Kaduna State Govnor Nasir El-Rufai don tell pipo of im state to continue dey spend di old 500 and 1000 naira notes.

Dis dey come afta President Muhammadu Buhari announce for broadcast on 16 February say im don give approval to CBN to allow old 200 naira to circulate as legal tender alongside di new 200, 500 and 1000 naira notes.

Buhari directive mean say di old 500 and 1000 naira no longer be legal tenders for Nigeria but El-Rufai insist say make pipo of Kaduna no disturb diasef as dem fit continue to transact business wit di old notes.

El-Rufai for media chat on 16 February say make Kaduna pipo stay calm and support di lawful means wey im dey use to solve dia problem.

β€œOn behalf of di Kaduna State Goment, I wish to assure you say none of you go lose di moni wey you get for old notes. Make you no allow artificial or illegal deadline to frighten you. Weda you dey live for towns or villages or for our isolated rural communities, you no need rush to deposit your old notes for bank, make you hold on to dem, continue to use dem as legal tender as di Supreme Court don order,” El-Rufai tok.