Di building wey dey for di Three Arms Zone, for Nigeria capital Abuja contain di of some justices.
E neva too clear wetin bin cause di fire, but fire fighters bin go quench di heavy fire.
Tori wey BBC neva fit to confam be say office of three of di Supreme Court justices burn. Di extent of di burn also neva clear.
However, Dr Festus Akande, Director Of Press and Information for Supreme Court confam say some documents burn.