Buhari launch oil fields for Northern Nigeria

November 22, 2022

Some residents of Bauchi state for northeast Nigeria say dem dey hope say di kick off of oil drilling for dia state go provide jobs.

Nigeria Presido Muhammadu Buhari go on Tuesday visit Kolmani area – di border of Bauchi and Gombe state for northeast Nigeria to kick off oil drilling for di area.

One resident Usman Tahir say e don tey wey im bele sweet am like dis as dem don dey wait tay-tay for dis oil drilling to turn to reality.

“Na since we small we dey hear say our state get oil but we no really take am serious until few years ago when exploration,” Tahir tok.

E say, “Now di main tin for us na jobs.

“Our state get one of di highest number of unemployed pipo and dis na opportunity for our pipo to get jobs wey go lift dem comot from poverty.”

For Adamu Warji goment need to dey sincere to provide jobs and infrastructure to avoid wetin happun for South South – “we no want environmental issues, we wan enjoy from di oil.”