Buhari call emergency security meeting- wetin to know

October 31, 2022

Nigeria President Muhammadu Buhari go on Monday meet with security chiefs for di nation capital, Abuja.

According to di tweet wey dey di verified handle of di Nigerian Presidency, di meeting na to further review and strengthen security network for di country.

Dis meeting dey come amidst series of security alerts from some foreign kontri over scare of terrorist atatck- di tweet no tok whether na sake of di terror alerts.

Di United States of America, United Kingdom and some oda kontris bin ask dia cirizens wey dey stay for Nigeria to comot quick quick for dia own safety.

Dis na as President Buhari bin call for calm saying make pipo no too dey fear over di alert wey dis foreign kontris bin issue.

Security agencies also say dem dey ontop di mata say make kontri pipo no worry but dey vigilant.

Di Nigeria leader wey dey initially scheduled to commission di National Agency for Science and Engineering Infrastructure (NASENI) new Technology and Innovation Complex, go receive briefs from di security chiefs, and interject on areas wey need more attention.

 Security mata for Nigeria don dey somehow for many years wit cases of kidnapping on di rise across di kontri.