Boniface Yarn as Super Eagles Stranded 12 Hours for Libya Airport

October 14, 2024

Nigerian forward, Victor Boniface, don yan about di wahala wey Super Eagles face afta dem strand for 12 hours for Al Abraq International Airport for Libya.

Di Nigerian team wey go Libya for di crucial AFCON 2025 qualifier, face unexpected delay afta dem land on Sunday.

Boniface express him frustration for X on Monday, im write say, “Been at the airport for almost 13 hours, no food, no Wi-Fi, nowhere to sleep. Africa, we can do better.”

Super Eagles land for Libya for their qualifier match against di host nation, but di chartered ValueJet flight wey dem carry, divert last minute from Benghazi Airport go di smaller Al Abraq International Airport, wey dem dey usually reserve for Hajj operations.

According to wetin di Nigeria Football Federation talk for statement wey dem release on Monday, dis diversion happen just as di pilot dey finish him approach to Benghazi.

Di unexpected change come leave di players and officials stranded without any reception or transport from di host Libyan Football Federation, even afta dem don make arrangements.

Di team suppose don go their hotel for Benghazi, wey dey about three hours away, but di diversion scatter all di plans.

For di NFF statement, dem talk say, “Fatigued players and officials have remained nonplussed as the host Libyan Football Federation failed to send any reception team or even vehicles to take the delegation members from the airport to their hotel, which is said to be three hours away in Benghazi.

Di NFF talk say dem make plans for separate vehicles for di team, but di diversion of di plane spoil all di arrangements.

Players don resolve say dem no go play di match again as NFF officials dey make plans to carry di team fly back home.”