Autopsy confam Davido son die from drowning

November 7, 2022

Di Lagos state police command on Saturday don reveal di result of di autopsy wey dem dey on di deadbodi of Ifeanyi Adeleke, son of Davido and im fiancée, Chioma Rowland, do come out.

According to di toktok pesin for di police command Benjamin Hundeyin, di cause of death of Ifeanyi death na ”drowning”.

E also tell BBC Pidgin for telephone interview say dem don transfer di two suspects wey dey dia custody go di state criminial investigation department (SCID) Yaba area of di state for further investigate.

Di three year old Ifeanyi Adeleke, wey be di fisrt son of di popular Nigerian Afrobeat star, Davido and Chioma die on di night of 31 October, for di musician house wey dey for Banana Island area of di state.

Ifeanyi death wey attract tributes from plenti ogbonge pipo around di world also raise concern over safety of pikin dem around siwmming pool.

Tori begin fly up and down early mor-mor on Saturday, 5 November on local blogs and social media plaftorms about di rumoured arrest.

But di police toktok pesin say ”dat tori na false. Nothing like dat happun”.

Di thing be say Eniola and Davido be friends wey dey always show affection to each oda ontop social media.

She be one of di few pipo wey pipo believe first drop hint about Ifeanyi death ontop social media though she later delete di post ontop her Istagram page – dis make pipo vex and drag her questioning di kain friemndship she share wit di pop star.

She never comot to tok anything.