Di cancellation happen afta di Indonesian city withdraw as hosts based on say di Indonesian government no release di budget for di Games, and dis no give di Olympic Committees time to find alternative.
Bali bin dey plan to host di second edition of di World Beach Games, wey include 14 sports like beach soccer, beach volleyball, and surfing. Make we remember say Indonesia bin lose di rights to host di 2023 FIFA Under-20 World Cup earlier dis year.
But for dat matter, di decision bin happen afta di country’s football federation (PSSI) yan say dem cancel di draw sake of di governor of di largely Hindu island of Bali refuse to host Israel’s team.