Emefiele suppose take im plead for court today but surprisingly di Registrar for court confam to tori pipo say di case no dey for dia cause list.
Dis one mean say di case no dey among di cases dem go hear today.
Justice Hamza Muazu of di Federal Capital Territory, FCT High Court bin adjourn di arraignment of di former CBN govnor Godwin Emefiele to 23 August 2023 afta counsel to Nigeria Goment Muhammed Abubakar beg court to adjourn di arraignment sake of say one of di defendant Sa’adatu Yaro no showface sakenof say she sick.