Wahala don burst for camp of ruling All Progressive Congress (APC) as dem dey confused for hours after principal officers emerge for di 10th Senate.
After di Senate President Godswill Akpabio announce di new officers, di Chairman of APC, Abdullahi Adamu, don talk say di list of principal officers no come from di party secretariat.
Adamu bin yan dis one for meeting with PROGRESSIVES GOVERNORS’ FORUM wey Governor Hope Uzodimma of Imo State lead, and later e talk say di party go address di “communication gap” between di four most senior NASS leaders and APC.
Senate President bin announce Senator Opeyemi Bamidele from Ekiti State as Senate Leader, Senator Dave Umahi from Ebonyi State as Deputy Senate Leader, Senator Ali Ndume from Borno State as Chief Whip, and Senator Lola Ashiru from Kwara State as Deputy Chief Whip.
Akpabio sef bin announce names of minority principal officers; Senator Simon Davou (Plateau North – PDP, Minority Leader), Oyewunmi Olarere (Osun West – PDP, Deputy Minority Leader), Darlington Nwokeocha (Abia Central – LP, Minority Whip) & Rufai Hanga (Kano Central – NNPP, Deputy Minority Whip).
Similar thing happen for House of Reps as Tajudeen Abbas announce Julius Ihonvbere (APC – Edo) as House Majority Leader, Halims Abdullahi (APC – Kogi) as Deputy Majority Leader, Bello Kumo (APC – Gombe) as Chief Whip, and Adewunmi Onanuga (APC – Ogun) as Deputy Chief Whip.