Akwa Ibom enact bill to regulate price of food items

February 23, 2024

Akwa Ibom State Govnor, Umo Eno, tok say im don sponsor one bill wey dey before di State House of Assembly to tackle di cost of living crisis im pipo dey go through.

E say di Bill for di establishment of di State Bulk Purchasing Agency, na to ensure say pipo go fit afford di price of staple food items.

“We go buy di food items in bulk and ensure say e dey available to our pipo for relatively lower prices. Di process go dey transparent,” Govnor Eno tok for tweet e post on X.